Connect with us


Music

2Baba – Rise Up Ft. Falz

Published

on

2Baba – Rise Up Ft. Falz Lyrics

Rise Up lyrics

“Rise Up”

 

As gbege dey happen around the world

And the news wey full for air

Dey make liver dey fail you

Dey make spirit dey dampen

So, ma guys na your eyes you go sharpen

You need to take care of yourself

Cos the curve go flatten

Better go dey start to dey happen

 

Know say gbege go come and go

Ebelebe, we suppose to jump am o

Ebelebe, you suppose to know say

We must to rise up again, eh

Gbege must come and go

Ebelebe, we suppose to jump am o

Ebelebe, you suppose to know say

We must to rise up again, eh

 

Yawa dey today but hey morrow go better

Gbege wey dey now e no go kill us never

I collect 1 Trophy make I take forget am

2 bottles with 2Baba we dey for gether

Make I keep am short o mi o fe soro ju

Everybody know say all my people dem dey colorful

When the gbege jam us for body we lost 1 or 2

And the matter hook us for neck we no no what to do

Stop there, turn round you go see action

Where man fall down, he go still rise up

Weytin no kill man na weytin make him sharp nah

And you no fit die for your film na you be actor

You go wide the chest like you be man o’ war

You go wipe the dirt like you be janitor

You recharge the energy and start afresh

Weather you dey Budapest, Lagos city, Marrakesh

 

As gbege dey happen around the world

And the news wey full for air

Dey make liver dey fail you

Dey make spirit dey dampen

So, ma guys na your eyes you go sharpen

You need to take care of yourself

Cos the curve go flatten

Better go dey start to dey happen

 

Know say gbege go come and go

Ebelebe, we suppose to jump am o

Ebelebe, you suppose to know say

We must to rise up again, eh

Gbege must come and go

Ebelebe, we suppose to jump am o

Ebelebe, you suppose to know say

We must to rise up again, eh

 

The pepper go still rest, e go still rest ceteris paribus

Better go still come wey flexing go dey unanimous

All of my people turn, dey turn up till maximum

Bad water wey dey flow come no fit carry us

As I dey talk am so n gbo, sho gba mi gbo

All the kwanta wey you think say kole pari mo

Sofun Tolani, Chidera pelu Amina

Pe adura wa tigba ka ma sha mi mo

To the heroes we lost, we no go forget

Heaven prepare the medal wey dem go collect

Our black panther don unite with black mamba

When the time come, we go still jam for wakanda

When you get up help us, halla captain chika

And God bless the souls of Uwa and Tina

The time tough but no matter how e rough

Bad water wey dey flow come e no fit carry us

 

As gbege dey happen around the world

And the news wey full for air

Dey make liver dey fail you

Dey make spirit dey dampen

So, ma guys na your eyes you go sharpen

You need to take care of yourself

Cos the curve go flatten

Better go dey start to dey happen

 

Know say gbege go come and go

Ebelebe, we suppose to jump am o

Ebelebe, you suppose to know say

We must to rise up again, eh

Gbege must come and go

Ebelebe, we suppose to jump am o

Ebelebe, you suppose to know say

We go rise up again

 

This thing just wan test every man

The same thing dey happen inside inna every land

E no be competition

This one no concern politician

E just wan test every man

Same thing dey happen for every land o

This no be competition

This one no concern politic… politic…

 

As gbege dey happen around the world

And the news wey full for air

Dey make liver dey fail you

Dey make spirit dey dampen

So, ma guys na your eyes you go sharpen

You need to take care of yourself

Cos the curve go flatten

Better go dey start to dey happen

 

Know say gbege go come and go

Ebelebe, we suppose to jump am o

Ebelebe, you suppose to know say

We must to rise up again, eh

Gbege must come and go

Ebelebe, we suppose to jump am o

Ebelebe, you suppose to know say

We go rise up again

 

 

Trending